This End-Time Swag
Me ma, I tight -
I no dey BRAG
My weight no light -
I no join FRAG
I too dey bite -
Bros, I sabi GAG
You no like am? Make we fight
But check out my super swag.
My blood dey hot
Which person tongue dey wag?
Remove that rubbish malt
Hoist my "Chelsea" flag
No try my temper - just
take a look at my mag
And in case you smoke "pot"
Make you check out my super swag!
Repent! Abi una dey hear me?
Devil na ugly hag.
Holy Spirit no gree let me be
So I surrender make Him give me tag
Bad life no pay - Jesus die for we
So we no go carry last like stag
If you still dey doubt my new kind of tea
Check out this my End-time swag.